Kim Kardashian divorce Kanye West?: Kanye delete divorce tweet but Kim open up for Instagram stories say na bipolar disorder cause am

Kanye West Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Kanye West

Wetin we call dis foto, American rapper Kanye West na Kim Kardashian husband and US President Donald Trump friend.

America rapper Kanye West bin post for twitter for Wednesday morning say im don dey try to divorce im wife, Kim Kardashian, wey be reality TV star, but he don later delete di tweet.

"I bin try to divorce Kim since she meet wit Meek for Warldolf Prison reform," West tweet and im no give more informate.

  • 'Show compassion' - Kim Kardashian respond to Kanye West tweet

Kim Kardashian later admit in public for di first time say na bipolar disorder cause am.

She announce am for her Insgaram stories on Wednesday afternoon wia she ask pipo to try understand say di mata don really affect she and and family reputation.

  • See facts about Kanye West wey you fit no know
  • Read Kanye West main points from im speech during im first presidential campaign

For Monday night, Oga West bin post some tweets wey im late delete, e claim say im wife dey try to lock am up on top health mata and because say im dey compare himself to Nelson Mandela.

All dis tins happun one day afta West launch im presidential campaign for Charleston, South Carolina. For that event, West tok how decision say make im wife no do abortion.

Im wife representative for that time no comment on top dis mata.

Di 43 year old rapper na former supporter of President Donald Trump, he don make pipo begin dey wonder if dis im presidential ambition na real or na anoda publicity stunt to take sell im album.

Before Kanye tie di knot wit Kim, im first wan marry designer Alexis Phifer wey im dey date since 2002.

Dem engage for 18 month before di two wey-for-be couple say dem no do again and scatter dia engagement.

  • US Ogbonge rapper Kanye West wan run for 2020 America president - See who dey give am support
  • Trump admit say coronavirus pandemic go 'get worse'

Read Kanye West main points from im speech during im first presidential campaign

Kanye West for im first presidential rally

Wia dis foto come from, Reuters

Meanwhile Kanye West don officially launch im campaign for di 2020 US presidential election, with one uncommon rally for Charleston, South Carolina.

West, wey be 43, dey run as a candidate for im self-styled "Birthday Party".

For di event, di rapper begin make policy decisions wey dey off-di-cuff, as im go on plenti rants - including tok on abortion and on Harriet Tubman.

Wetin Kanye West tok for di rally?

Kanye West believe say abortion must remain legal for di US, but im tok say financial support must dey for every struggling new mothers - E even suggest say "everybod wey get baby go get one million dollars".

"Di only tin wey fit free us na by obeying di rules wey dem give us for a promised land," he tok. "Abortion should dey legal because guess wetin? Di law no be by God anyway, so wetin be legality?"

At one point wen e dey tok about abortion, he begin cry, say im parents almost abort am: "Kanye West for no dey, because my papa dey too busy."

He add am say: "I almost kill my daughter... even if my wife [Kim Kardashian West] go divorce me afta dis speech, she bring North into di world, even wen I no want am."

Slave trade still dey happun

For anoda moment, he give one impromptu monologue about 19th century abolitionist Harriet Tubman.

"Harriet Tubman no actually free di slaves, she just make di slaves go work for other white pipo," he tok - dis statement make pipo from di audience make some noise.

He also dey like say im wan cry wen im tok about im late mother, who die for 2007 from complications during cosmetic surgery.

  • Ronald Regan, Jerry Springer and oda American celebs wey turn politicians

Kanye West get chance to dey on state ballots?

West, wey announce im candidacy on 4 July, don already miss di deadline to qualify for di ballot in many states. He go need to collect enough signatures to appear on di ballot in a number of oda states.

Last week im qualify to appear on Oklahoma's presidential ballot,di first state wia im meet di requirements before di deadline.

If im wan appear on South Carolina ballot he go need to collect 10,000 signatures by afternoon local time (18:00 BST) on Monday.

How pipo react to im election campaign